New Monetary Policy Go Fix Naira & Go Slow Down Tok -Shonubi

8 months ago
Please Share to your Social Media
Please Follow Naijamerit on Social Media
News Home More from Hot Tori

President Bola Tinubu don direct di Central Bank of Nigeria (CBN) say make dem apply strict monetary policies wey go fit balance naira and add ginger di nation's economy.

Di acting Central Bank governor, Folashodun Shonubi, com out tok dis one  on Monday afta he don receive informant from presido.

Shonubi, wey nor really open mouth tok di specific measures wey CBN go take, E kon tok say currency pepo go lose big amount of money wen di measures dey for place.

Di acting CBN governor kon still add say supply go go up for days wey dey com wey go help wit di  foreign exchange market.

"Mr. President is very very concerned about some of the goings on in the foreign exchange market. We have discussed and shared with him what we're doing to improve supply. If you look at the official market, you will find that that market has been fairly stable and the spreads of the difference have not fluctuated as much,” E open mouth tok.

“We do not believe that the changes going on in the parallel market are driven by pure economic demand and supply but are topped by speculative demand from people.

“Some of the plans and strategies which I'm not at liberty to share with you, mean sooner rather than later, the speculators should be careful because we believe the things we're doing when they come to fruition may result in significant losses to them.

Hot Tori go still drop about di new policy, and na CBN go open mouth tok for dis one.


How una see dis mata??
#Chookmouth

More from Hot Tori

Oil Sellers Don Cum Out Tok Say Dem Go Add Money For Petrol Price To N720/Liter

Oil sellers for obodo naija don warn say di fuel price fit add money anytime soon, and e go dey between N680 and N720 per liter.

FIFA Women's World Cup: James Don Get Two-Match Ban for Di Alozie Stamp

Di Federation of International Football Association (FIFA) don knack England dia Round of 16 clash with Nigeria for Brisbane on Monday. Di Federation of International Football Association (FIFA) don knack England dia Round of 16 clash with Nigeria for Brisbane on Monday.

SERAP Go Sue Akpabio On Top Di‘Holiday Allowances’

Di Socio-Economic Rights and Accountability Project (SERAP) tok say e go sue Senate President Godswill Akpabio on top say him dey give “holiday allowances” to senators by di Clerk of the National Assembly.

Two people die, Five oda people injure for Eko Bridge Accident.

Two people die for inside accident wey involve six private cars for Eko Bridge on Wednesday.

Tinubu Don Order New Sanctions on Top Niger

Presido Bola Tinubu don tell di acting governor of di Central Bank of Nigeria (CBN) to knack new financial sanctions to di ones wey first dey on top Niger Republic.

Nigerians Dey React as Adamawa Governor Appoint 47 Media Aides

Pipo don dey react follow di appointment of 47 media aides by Governor Ahmadu Fintiri of Adamawa State.

NLC Don Suspend Di Strike Afta Presido and Senate Chook Mouth

Di National Labour Congress (NLC) don suspend dia planned strike afta Presido Bola Tinubu chook mouth come get emergency meeting with di Senate.

16 Join Bodi For North No Gree Follow NLC Protest Today

16 Northern joinbodi no go join NLC for dia strike.


Read full article
Please Follow Naijamerit on Social Media
< Back | News content